Just received this email, will post it exactly the way it was sent to
me. Hope some of you know how to read pidgin English. This is so sad.
Read below…
If i dey insult and yab our Government,many
people go feel say,i dey carry yarn,becos maybe dem dey benefit from
the Government,so dem nor wan hear any wrong thing about the Government.
The parents of this wonderful kids don get
other Children but d woman dey find Girl pikin. Na so God come throway
two Girls give her according to SCAN wey she do. After many hours for
Labour for Sapele General Hospital. Doctors c*m find out say if one of
the child dey push come out,say something dey drag her back dey go
inside. So them c*m prepare the Woman for C.S.

My people before God and Man,na “Cojoin
Twins” nai d woman produce. After them bring down the children,nai dem
contact me,say them get major issue wey pass them for the Hospital.
Before i reach the Hospital,i don put on all my Transmitting machines
and CCTV camera’s. My dear people of Sapele from the hour of
delivery,these children nor last reach 2Minutes,before dem give up.
WATER ALMOST FINISH FOR MY EYES. How on earth person go carry pregnancy
for 9months,only for her to deliver wetin our Health sector nor fit
protect? Wetin c*m be the need of the Hospital without basic facilities?
E don tey when i dey complain say Sapele General Hospital nor get
simple Oxygen and other facilities to meet up our present health
challenges,but nobody dey give listening ears. When i reach the ward to
go examine the Babies,i c*m find out say,na Oxygen dem say,dem use
sustain the kids or else dem for die earlier than the period wey dem
stay. If we look well for deir pictures under,we go see say,somebody
hold oxygen dey inter-change am for the babies to gasp in air to
survive. From dis picture,unu go agree with me say,na lack of equipment
nai kill dis children becos if the two kids get deir individual Oxygen i
nor think say,dem for ever die fast at all,if at all say dem go die for
dis tender age.
How a whole SAPELE GENERAL HOSPITAL nor go
get Oxygen? Report reach us say our Governor pronounce say Delivery na
free for all pregnant women,but if you mistake enter Labour for
30minutes,the baby norva c*m down,the wicked nurses wey dey General go
just begin dey abuse patients,before u know,them don refer you for
C.S,and after the d delivery dem go charge you almost N40K. How dat one
c*m take be free?
I don dey talk am before say na who get something nai suppose know
the value. Our Community Leaders wey suppose use deir influence beg
Companies to donate some of dis facilities to our Hospital refuse to
talk. Na to chop land money nai concern unu. When i research about
Cojoin twins i c*m find out say to separate dem dey hard in most cases
becos them dey mostly dey share dsame Kidney,Heart,Liver and other human
parts. Most especially when dem gum eachother from the Belle side. But
dem dey survive and leave well among us. Cojoin twins don become
Minister of Health,Engineers,Doctors and other professioner jobs,wey
contribute deir own quarter to the betterment of the world. Though i
know say we still dey behind to handle such issues but the kind money
wey dis Government dey put into Health and where as nothing dey
happen,dey very alarming. I dey very sure say the only Oxygen wey
General Hospital manage get,nor even dey in good working order and nai
make we quick lost this children.
Today i dedicate this morning to dis our priceless kids wey God use
take test our medical sector and expose deir anus. As i call on all of
us for dis forum to pray for deir Souls. Them deliver the children on Friday wey pass so and dem die dat same friday for same Sapele General Hospital.
Source: LIB
0 comments:
Post a Comment